{Verse 1 – Brymo}
Everybody say them dey go their way
But I no think say, say we dey block each other way
Lai Lai,
You no go hear the people say,
Say na our ignorance dey make life hard
{1st Chorus – Brymo}
Heya!
Heeeya!
Some dey talk and some dey walk and time just dey pa** us by
{Verse 2 – Brymo}
Every woman dey look for man wey go love her right
Wey go ignore her shortcomings
Wey go take her like that
And every man dey look for woman to hold tight
But na ignorance dey let love down
{2nd Chorus – Brymo}
Heya!
Heeeya!
Some dey come and some dey go and love just dey pa** us by
{Verse 3 – Brymo}
I don dey stubborn since the time I be small pikin
Na me dey always first see the problem, eh ah eh
Na me dey quit last, I no dey run fast
Papa say make I live freely like rich man pikin
{3rd Chorus – Brymo}
Heya!
Heeeya!!
I just dey fall, I just dey rise and time just dey pa** me by
{Outro – Brymo}
Heya!
Heeeya!!
Some dey laugh and some dey cry and time just dey pa** us by
Some dey work and some dey pray and time just dey pa** us by